

As you fit don know, my name na Miss Odineka for internet. But for real life my name na Mrs. Odinekachukwu Ishicheli-Ossai. Make quarrel for no dey make I tell you why I dey use Miss Odineka instead of Mrs. When I first dey think about name to use for my technology part of my life, nothing come my head. Only be say everybody wey dey call me normal normal dey call me Odi. All that time, I never marry, I never even think marry sef, na so I just decide to stay with my name as Miss Odineka. Na after that time marriage con come.ย If you wan dey call me Mrs, no wahalaย
Now I wan ask my qweshion again, how I fit help you? Which of my hand work you need?
ย I dey help small business them dey package their brand for internet with website. Some of the websites wey I don build naย sparkledotspa.com,ย darshnaturals.com,ย reniologe.com,ย maxivive.com and many others too. You fit check my portfolio page to see other website them wey I don do.
I don dey write tey tey for people. I first start to dey write on top Blogger for around 2012/2013. From that time reach now, I don write for different brands like Rough Africa, Made Magazine, Accelerate TV and some other too.
I collect certificate from Google for digital marketing, so if you want person wey go show you way for market for internet I fit help you.
No vex I know sey that English plenty small ๐ . E mean sey I dey help people design their social media account make e fine for eyes. Remember that my post wey talk about "Aesthetics", I fit help you package your Facebook page and Instagram page make e dey ghen ghen.
I still dey sew too: But that one na for myself o ๐ ๐ ๐ except sey you won pay me plenty money.
As I don gist you now, which of my hand work you dey find person for? You fit contact me for here!
ย