How May I Help You?

How May I Help You?

As you fit don know, my name na Miss Odineka for internet. But for real life my name na Mrs. Odinekachukwu Ishicheli-Ossai. Make quarrel for no dey make I tell you why I dey use Miss Odineka instead of Mrs. When I first dey think about name to use for my technology part of my life, nothing come my head. Only be say everybody wey dey call me normal normal dey call me Odi. All that time, I never marry, I never even think marry sef, na so I just decide to stay with my name as Miss Odineka. Na after that time marriage con come.๐Ÿ˜‹ย If you wan dey call me Mrs, no wahalaย ๐Ÿ˜

Now I wan ask my qweshion again, how I fit help you? Which of my hand work you need?

Everyday Deals
web design
writing

I still dey sew too: But that one na for myself o ๐Ÿ˜…๐Ÿ˜…๐Ÿ˜… except sey you won pay me plenty money.

As I don gist you now, which of my hand work you dey find person for? You fit contact me for here!

ย 

Women's Fashion Category